Categories: Lyrics

E Dey flow – Moses Bliss, Neeja & A-Jay Asika Ft.Festizie, Chizie & S.O.N Music)

E dey flow
Oil for my head dey flow
No be wash oh
If u check am you go know.

Blessings choke
From my head
Down to my toes
No be joke oh
Even for my face e Dey show

I no fit count
I no fit count oh
The blessing of God upon me life oh
See as my life e don balance oh
Na the grace of the lord
Taking me high

No be fantasy
Your love is my reality
The anointing dey break the yoke
All of dem Dey believe
Say my God no Dey bobo

The way you pamper me
Steadily oh
Surprising me constantly oh
Boosting my energy oh oh
This your love no be fallacy oh
Even the blind can see oh
Wetin u do for me oh

E dey flow
Oil for my head dey flow
No be wash oh
If u check am you go know.

Blessings choke
From my head
Down to my toes
No be joke oh
Even for my face e Dey show

The oil flowing steady
Comot the boy from trenches
Hilux no fit pack my blessings
I Dey on God so I’m never stressing
“No ooh”

Falala Falala
Under the umbrella
I get eternal life
Me no fit suffer
My daddy Ogaranya
E put the oil for my head

When I look around oh oh
Everything I Dey see
Just Dey make me believe say
Oil Dey my head oh
As u see me Dey shine oh oh
Sapa and me be like bread and tea before
Jehovah help me oh

Now I don Dey select
Odogwu na my connect
All of my songs just Dey make sense
Oil Dey my head oh
Na the word I Dey confess
Wey come dey make e me the best
Who God don bless no man contest
Oil Dey my head oh

E dey flow
Oil for my head dey flow
No be wash oh
If u check am you go know.

Blessings choke
From my head
Down to my toes
No be joke oh
Even for my face e Dey show

E dey flow
Flow, flow, flow, flow, flow
Oil for my head dey flow
Flow, flow, flow, flow, flow
Oil for my head dey flow

HOW HAS THIS IMPACTED YOUR LIFE?

I-solo

Music, research, friendships and love are the things that excite me

Leave a Comment

Recent Posts

Transformation – Limoblaze

I've been on the road every day for the past six months And if You ask how I'm doing, I…

3 weeks ago

Victory – Limoblaze

Trouble may come my way, yeah, but I will keep my faith in You And if I lose my way,…

3 weeks ago

Rest – Limoblaze

All that my heart desires Let it be You alone Nothing can quench this fire My heart is set in…

3 weeks ago

Wait – Limoblaze

They said I lost my mind 'cause I believe in what I can’t see They said I lost my time…

3 weeks ago

My time – Limoblaze

My time, my time Everything go align My time, I go shine Nothing go touch this design Oh my time,…

4 weeks ago

Happy – Limoblaze

Ko saaye Omo se die die Rora se die die O ni Baba loke to n korede o Sunshine on my lips…

4 weeks ago