Categories: Lyrics

Hero – Tim Godfrey & D Xtreme Crew


Verse 1
Wetin I for do who I for call o
If e no be You how I for run o
Baba o, na You rescue me e e e
No money for pocket
No food to eat
My shoe na so so alignment, no house to sleep
You come rescue me
That’s why You be my hero

Chorus
Oh na only You be my Hero
Na on only You I go follow
Why You love me so…
Even when I don loose hope
Everybody give me long rope
You come rescue me
That’s why You be my hero oh

Verse 2
Na so dem dey call me mumu
Their mouth dey chop me like fufu
Dem yab, dem laugh me, reject me, eject me
Dem even say I no go school
Thank You baba u no dey look face, thank You
Baba You no get two face, na You rescue me
That’s why You be my hero.

Bridge 1
I dey lonely, only me
You come love me
Come lift me
My spirit, my soul take control, my heart and
My love
My hero oh…oh…my hero

Bridge 2
When dem reject me, eject me, dem wound me
Dem wan kpai me, dem no know say na
Because of You i still dey o!

Refrain:
Na only You be my hero
Na only You I go follow.

HOW HAS THIS IMPACTED YOUR LIFE?

Oluwarufus

God, Technology, Music .....in that order

Leave a Comment

Recent Posts

Performance – Incence & Fisayo Check Odebode Ft. Victor Akande

Scripture says He watches over His word to perform it If He said it I believe it What He says,…

1 week ago

Make Room – Incence & Fisayo Check Odebode Ft. Tosin Awoniyi

God is in our midst Right here right now Filling us with grace And more of Him God is in…

1 week ago

Yahweh – Incence & Segun Israel Ft. Tosin Awoniyi & Victor Akande

I could sing a song of love to Yahweh Yahweh, Yahweh, Yahweh Yahweh, Yahweh, Yahweh Oh how You love me…

1 week ago

Mercy – Dunsin Oyekan

I have tasted of Your mercy And I have come to realize There is nothing like it When You decide…

2 weeks ago

Not Over – Laolu Adewunmi

Oh oh oh oh oh Oh oh oh oh Oh oh oh oh oh Oh oh oh oh Hey brother…

2 weeks ago

At your Feet – Incence, Seun Ajetunmobi & Fisayo Check Odebode

A thousand years like a day gone by That I may dwell, here in Your arms To gaze on beauty…

2 weeks ago